kalimah.top
a b c d e f g h i j k l m n o p q r s t u v w x y z 0 1 2 3 4 5 6 7 8 9 #

vickers – no soft boys allowed كلمات اغاني

Loading...

[verse 1: vickers]
no soft boys allowed where you think you dey
na wetin your eyes dey find you go see today
just dey waka dey bounce with your little chain
we don catch you, no dey look people face
dem no fit help you, na we dey run the streets
n.s.b.a we go show you wetin that warning mean
no chains or sneakers, phones or designer clothes
and if your face nor rugged, my guy go home
before we daze you, disgrace you, obtain you, you big fool
cooperate, if we chase you, we go waste you, this pistol
go burst like pimple, your body go fly like eagle
for hospital, dem no go fit solve your case like hard riddle
i go leave you with this piece of advice
if you see one of my guys, tender everything wen you get
or everything go red, no peace on this side of town
we screaming aloud, “no soft boys allowed!”

[chorus:vickers]
no soft boys allowed, where you think you dey
na wetin your eyes dey find you go see today
guy shine your eye, na warri you dey
and if your face no rugged, you no fit to stay

[verse 2: vickers]
no soft boys allowed, na wetin dem tell me
as dem corner me, the very day when i step in
omo see begging, as i see the pistol
but all the people do like say dem no hear me
e fear me when dem say make i remove my clothes
point gun for my head, collect my chains, my shoes, my clothes
as i dey look na so, one of them punch my face
na then e come explain, how dem dey run the place
say if i want to stay, by force i gotta blend
my face mus’ rugged, i dress like how dem dress
n.s.b.a , e tell me wetin that warning mean
guys wen fit stab you dey look you till your heart stop to beat
the choice na just to leave or to join the clique
and you go know my choice, man, if you just believe
say the guy, wen rap for verse one na me
till i leave the town, i vow, “no soft boys allowed!”

[verse 3: vickers]
no soft boys allowed, that’s how the story goes
don’t be told, it’s kamikaze going home
no sleep, no peace, home is dangerous as lonely roads
don’t speak to n0body, watch where you’re going to
cause any minute, you can get it, if you push ’em to the limit
or two communities fighting, and you get caught in between it
i’m sorry for you, better find something to do
than to lose your life at the hands of those who have nothing to do
don’t go out after the curfew, 7 o’clock is midnight
or a street guy could rob you, shoot you out of spite or in fright
just giving the insight, these laws run the streets
n.s.b.a, now you know what the warning means
“am i a street guy? “, well not really
i’m just giving you facts that you can trust to be
and sure it’s me, making them all to scream
their lungs out, singing “no soft boys allowed! ”

[outro: sifon]
no soft boys allowed oh
if you waka anyhow, you go see anyhow oh
vickers! maro kl-ssiq!
sifon! we live, we live !
let’s gooo!

كلمات أغنية عشوائية

اهم الاغاني لهذا الاسبوع

Loading...