kalimah.top
a b c d e f g h i j k l m n o p q r s t u v w x y z 0 1 2 3 4 5 6 7 8 9 #

sound sultan – area كلمات اغاني

Loading...

yeah
sound sultan, naija ninja
hiya!
kennis
you know how we dey do am
this one na go all my brothers wey don dey go outside naija
wey don ja comot for naija
always try to dey look back because there’s no place like home
yknawmean?
yoruba man tell me say ajo o dabi ile
and na true men
check this out
oh oh
yeah yeah yeah yeah yeah oh
eh
ajo o dabile eh
no matter where you go make you no forget area o
area o
na naija
ti ode ba ti le pada wale o
walе o oo uh o
how i wish say
i fit reach you anywhere you dеy eh
you dey eh
far away eh
that one no say make you dey bone area o
motherland iyo na your area
chinedu somebody borrow you ego
make you take travel go chicago
remember nnamdi sell him car
so you go go america
all these people wey been dey raise you
still dey stay for face me i face you
you promise say you no go fashi them
every other month you go dey tachi them
hillary wey you been promise to marry
still dey wait o’ boy she don tarry
when she go see you na inside ovation
you marry oyinbo from another nation
use mago mago get dough
now your oyinbo wife don know
next thing you know she don go report you
wetin you know them don deport you
i wish say
i fit reach you anywhere you dey eh eh eh
you dey eh eh eh
far away
that one no say make you dey bone area o
motherland iyo
ajo o dabile ee
no matter where you go make you no forget area o
area o
na naija
ti ode ba ti le pada wale o
wale o
you been say na 1 year
e come turn to 2 years
e don go for 7 years
but you dey serve 11 years
even when your papa pai
plus the tears your mama cry
bayo for chicago
them dey miss you for okoko o
biodun for canada
your mama still dey wonder
igba wo lo to ma pada o
remember for naija you get iyawo
ko da bi ile
ko da bi ile
ko da bi ile e
ko da bi ile
ko da bi ile e
ko da bi ile e
ajo o ma da bi ile e
how i wish say
i fit reach you anywhere you dey brother meh
you dey eh
far away
that one no say make you dey bone area o
motherland iyo
you say you go call
everybody wait tire for your call
rote o, why you go like so o?
from germany, to carry coco enter yankee
but then coco burst for your belle
rest in peace
you fly away
how come one day wey fun dey you fit come back o
your papa land o
i understand say u been so far away
long long way from home
long long way from home
you got a long long way from home
long long way from your papa land
ajo o dabile eh
no matter where u go make you forget area o
area o
na naija ah
ti ode ba ti le pada wale oh oh oh oh oh yeah
sound sultan
naija ninja
we doing it
all my brothers in the west
all my brothers in the east
north south
you know how we doing it
and all these people wey dey rule us
make una try make naija sweet
so that people go dey come back home
make we get water, light e.tc
respect
kennis music
peace out to you
now we doing it
kennis
respect, respect, respect
all my people in the house

كلمات أغنية عشوائية

اهم الاغاني لهذا الاسبوع

Loading...