kalimah.top
a b c d e f g h i j k l m n o p q r s t u v w x y z 0 1 2 3 4 5 6 7 8 9 #

six foot plus – e don do me كلمات اغاني

Loading...

this is for all those
who found themselves in situations they’d rather not be in
maybe by their making, by some wrong decision

or maybe by chance, circumstances
it’s time to break free
scream will me!
e don do me!

i dey stay with my uncle my portion dey double
of the work wey i get to do see me see trouble
my me dey eat the smallest ration dey wash the most plate
him children nothing dem dey do, people for god sake
na me dey wake up first na me dey sleep last
na me dem dey beat because i no dey fit pass
but how i go pass when i no fit rest
from sunrise to sunset my life na so so stress
if i say make i relax small my uncle go dey hala
the thing dey break my head like say i sleep for banana
the fall when i wan fall even the ground no dey
because the wife contribute to make me suffer sotey
i look up i look down i no dey happy throughout
mek i run? i think am
hmm hmm no need to pull out
but if i make mistake na knok i dey receive
so one day my uncle try am himself e no believe
na so i grab him hand suspend the knok
he call my name i answer hmm uncle mek we talk
your children no dey see the kind wahala i dey see
if i wrong correct me, dem no force you make you carry me

i say, i say, i say, i say
oh lai lai
i say, i say, i say, i say

e don do me
e don do me oh
e don do me
e don do me oh lai lai
lai lai

mr agada e too dey beat him wife
meanwhile him wife love am like die wetin be life?
day in day out her own na to please the man
no matter how hard she try the man no wan understand
black eye today, black eye another day
listen to agada him get something to say
you no say no be say i like wetin dey happen
and it’s not all fights at time me and my wife dey gbadun
apologies definitely i dey drop
na my temper dey make me go over the top
small things dey irritate me, my wife i know she loves me
i love here too but i can’t stop treating her badly
foolish man you no go stop before you k!ll am
we know it’s in your nature but then try to control am
another day another blow in the eye
one injury too many make the woman decide
i can’t take it anymore all these brushes what for
instead of love and respect i dear my husband the more
love becomes hate na thin line dey between dem
enough is enough she ran away with the children

she say, she say, she say, she say
oh lai lai
she say, she say, she say, she say

e don do me
e don do me oh
e don do me
e don do me oh lai lai
lai lai

the only way to get to chop for my country
na to dey for government or to know person for government
poor man like me how i go fit to make am?
mek i wait for my turn abi mek i go quickly take am
by force because the way i see am nothing lost
bros garri still cost na we dey pay the cost
i gats casala because i don see wahala
while other people dey julobi people see me see wahala
i wan believe say oneday these suffering go make sense
but for how long we go dey dey manage will we ever get there?
to hear the c_ck crow at dawn after the sunset
the nonsense is still in place because we consent
so i revote my hunger make me public enemy
i gain popularity but i no be celebrity
for dey time i no fit drag coat with my master
so for night i enter steal the coat from my master
for dey time i no fit drag coat with my master
so for night i enter steal the coat from him hanger

i say, i say, i say, i say
oh lai lai
i say, i say, i say, i say

e don do me
e don do me oh
e don do me
e don do me oh lai lai
lai lai

i say, i say, i say, i say oh
i say, i say, i say, i say

e don do me
e don do me oh
e don do me
e don do me oh lai lai

e don do me oh
lai lai
e don do me oh
lai lai
e don do me oh
lai lai
e don do me oh

كلمات أغنية عشوائية

اهم الاغاني لهذا الاسبوع

Loading...