kalimah.top
a b c d e f g h i j k l m n o p q r s t u v w x y z 0 1 2 3 4 5 6 7 8 9 #

josh feat. twest – on a low كلمات اغاني

Loading...

dem go deh act like na dem do pass
na dem know god and na we do jazz
for this hustle man no get time

na dem go school and na we get class
but still this hustle need sure for us
na man for himself and na god for us
so everyday me i grind and pray
i deh pray to oluwa
just like everyday, and so me sing say
ika poju ninu omo araye o… aaaahhh
say when you hustle better keep am on a low… aaaahhh
ika poju ninu omo araye o… aaaahhh
cuz no be everybody happy for your show
so brother keep am on a low low low low.

as i deh grind i deh shine
i no deh fake life and i no fake the grind oh
cuz i nor won lack behind
like girl with flat ass i nor won lack behind oh
but e no mean say i go deh carry body
with a low profile i deh make money (oh)
if e good or bad i deh thank the lord oh
i no be that type to deh tell the world oh
for social media you be hd for real life oh
you be 2d
make you put yourself for where concern you
another man life e no concern you
when i be the least you deh find fault
even now when i be first you deh find fault
if you see fault wetin you go take am dooo

dem go deh act like na dem do pass
na dem know god and na we do jazz
for this hustle man no get time
na dem go school and na we get class
but still this hustle need sure for us
na man for himself and na god for us
so everyday me i grind and pray
i deh pray to oluwa
just like everyday, and so me sing say
ika poju ninu omo araye o… aaaahhh
say when you hustle better keep am on a low… aaaahhh
ika poju ninu omo araye o… aaaahhh
cuz no be everybody happy for your show
so brother keep am on a low low low low.

oya keep am on a low low
make i tell you something you no know
some deh hustle everyday but no show
some when get for here go deh show show
they wonna bring us down but no no
they want make we ball with no goal
we progress they go vex that’s the plain fact
we fly first class they fly eco that’s the plane fact
we don too shake hands this year na leg we go shake
break haters face before day go break
big man mouth na to chop money
poor man na to shout
our own na to spend, their own na to doubt
some say we no get we deh package die
yes, na money dem take deh package guy
we deh hustle on a low but the voltage high
yes, the voltage high

dem go deh act like na dem do pass
na dem know god and na we do jazz
for this hustle man no get time
na dem go school and na we get class
but still this hustle need sure for us
na man for himself and na god for us
so everyday me i grind and pray
i deh pray to oluwa
just like everyday, and so me sing say
ika poju ninu omo araye o… aaaahhh
say when you hustle better keep am on a low… aaaahhh
ika poju ninu omo araye o… aaaahhh
cuz no be everybody happy for your show
so brother keep am on a low low low low.

كلمات أغنية عشوائية

اهم الاغاني لهذا الاسبوع

Loading...