kalimah.top
a b c d e f g h i j k l m n o p q r s t u v w x y z 0 1 2 3 4 5 6 7 8 9 #

jasën blu – my kontri كلمات اغاني

Loading...

naija na my kontiri, but e be
like say na stranger i be (for my fatherland)
see dem sars, army and police, den dey k!ll
omo naija destiny (oh yea yea)
slow steady den dey rob every hood of the promises
they made to we (yea yea)
and when i die for my kontiri
mama, make you no cry for me

ojo ti pe wey we dey talki say nigeri_yah go better
but every four years same animals dey run the same jungle yeh
upon the plenti plenti goodie goodie wey the baba take_i blessi we
my brother tell me when, beta beta go dey happen for my kontiri

if you love this kontiri o, make you stand up
if e tire you like me everybody stand up
if the matta dey worry you o, make we stand up
make we stand up, (make we stand up!)

as you dey hear dis song, my brother raise your hands up
we go run dis fight, the world go understand us

ijoba lie for my kontiri
den no getti mercy for you and me (for the motherland)
eniyan die for my kontri, lekki toll gate
na cemetery (october 2020)
we been don ready but den no ready know
say asiko don reach for freedom of the masses yea
buh we go rise for di country
and we go trample on the enemy

ojo ti pe wey we dey talki say nigeri_yah go better
but every four years same animals dey run the same jungle yeh
upon the plenti plenti goodie goodie wey the baba take_i blessi we
my brother tell me when, beta beta go dey happen for my kontiri

if you love this kontiri o, make you stand up
if e tire you like me everybody stand up
if the matta dey worry you o, make we stand up
make we stand up, (make we stand up!)

as you dey hear dis song, my brother raise your hands up
we go run dis fight, the world go understand us
if the matta dey worry you o, make we stand up
make we stand up, (make we stand up!)

october twenty, twenty twenty is plenty
many dreams were cut short many souls, emptied
from their body all of a sudden just for protesting
end sars no be threaten, na dem change the settings

omo naija sha lemi, mi oni f’owo osi juwe mi
ile baami on se telomi l’awon mo’yami fi gbemimi
for toll gate, who be the enemy, police or solider abi shey na me
freedom fighter kajii fulani, ab’awon t’ori camera kelani
ijoba kan ge wa, bi tailor wan tie ran wa
pa wa ti bi obe to sour, ko si’se f’awon odo wa
why youth no go loot, why hide the pot of soup
why you no dey tell the truth, the people knew you sent the troop

your people aje pako, ijoba ajeb_tter
e ti gbagbe p’omo taa ba ko, la gbe’le taa ba ti ko ta
naija we losing it e w’epo wa ninu gutter
eje ton san mo mean, leader of tomorrow slaughtered

if you love this kontiri o, make you stand up
if e tire you like me everybody stand up
if the matta dey worry you o, make we stand up
make we stand up, (make we stand up!)

as you dey hear dis song, my brother raise your hands up
we go run dis fight, the world go understand us
if the matta dey worry you o, make we stand up
make we stand up, (make we stand up!)

if you love this kontiri o, make you stand up
if e tire you like me everybody stand up
if the matta dey worry you o, make we stand up
make we stand up, (make we stand up!)

as you dey hear dis song, my brother raise your hands up
we go run dis fight, the world go understand us
if the matta dey worry you o, make we stand up
make we stand up, (make we stand up!)

كلمات أغنية عشوائية

اهم الاغاني لهذا الاسبوع

Loading...