kalimah.top
a b c d e f g h i j k l m n o p q r s t u v w x y z 0 1 2 3 4 5 6 7 8 9 #

iceboxx – government كلمات اغاني

Loading...

intro
(ou yae)
f-ck this shii (ou yae ae ae)
f-ck this shii (chopsticks chopsticks ) (ou yae)
mana badman (ou yae ae ae)
oh lord uh

verse 1 (iceboxx)
ibile ti igboro
i tire for the government
submit application i don’t need to seek your consent
why una dey do like people wey no get e conscience? (lord)
do like this, do like that
mtchww!!! nonsense (lord)
collect plenty money come dey use us as a collateral
i wish una goodluck nna much respect to jonathan
babanla na babanla o rest in peace to yaradua
buh anything wey happen to this pikin na in father do am
na beg i dey beg una o lead us by example
before we do experiment i’ll give una the sample
give us una time(time)
tell us una mind(mind)
voters registration i’ll be queuing up in line but it’s fine(oh lord) (fine)
enough with the criticism,(yh)how can i be a slave in a country wey i be citizen?(yh)
brother k!lling brother that na typical enemity(woo)
even policeman don dey complain of insecurity (woo)
when i vote for change i think say everything go change (change)
but the people in the government houses started acting strange(d-mn)
that na why i change the format make e favour me(favour me)
whatever happened to living in peace and harmony like oh my governor
government badoos if you want to speak your mind omo na trouble you dey find so (yh)
poverty dey choke us our people just dey die slow
na only you waka come? (woo)
why you want to carry go?

bridge
(government) economy of nowadays na truth or dare(government)
omo the matter just dey pain me this is so unfair (government)
this is so unfair guy the thing dey pain me die (government)
the thing dey pain me wella (oh lord)

verse 2 (iceboxx)
only work wey dey for streets now na nairabet(nairabet)
see as oga landlord just dey ginger for in house rent
a few enemies and positive energy(word)
na only poor people wey fit get up to a thousand friends (oh lord)
mehn we living in a man know man society (yea)
laziness and hangover the best cure for anxiety (ya)
i came into this world with like little or no property (woo)
i cannot come and k!ll myself(woo)
just to be an executive (woo) (gya)
i swear the matter don dey kpara me(ey) (chopsticks)
na only when dem need money wey dem go hala me (oh lord)
government never pay us o we never collect salary
these people just dey use my head
dem say dem won empower me
them just dey careless us,see as dem dey careless us(ya)
people wey we put for inside office don dey office us
(mamamama n-gga)
what the h-ll na wetin make your head dey swell omo dem put us inside pocket for their mind we be like walkie talkie
you see the matter now my brother how you reason am(lord)
four years for office be like movie and na seasonal(lord)
country be like cinema (yh)
all we do is looku looku (yh)
just dey hustle here and there omo na wuru wuru (word up)
na left to me alone i for no give am chance(give am chance)
left to me alone i for don fall in hands(fall in hands)
i for don spoil in plans(spoil in plans)
i for don switch am up(switch am up)
i for just do like i no send i for no show am love (gii am love)
na with god you know say anything is possible
buh vision 2020 just be like mission impossible (lord)
you go fear fear (yh)i say you go fear fear(yh)
cuz last year and this year
go determine the next year (woo)
oga presidoo eh we dey hear from you o(hear from you o)
i just dey pray make this election no go change your mood (no go change your mood)
incase of incasity oo baba i go dey my room(woo)
i no won shoot bed e mama fly
i go dey pray for you(lord)
nna shame on you just look at the things you do(lord) or maybe you should visit the ghetto and spend a day or two (yh)
e be like na house arrest o anything you say or do(word up)
omo baba lowo no worry i dey with mayorkun(oh lord)
word!!!

كلمات أغنية عشوائية

اهم الاغاني لهذا الاسبوع

Loading...