kalimah.top
a b c d e f g h i j k l m n o p q r s t u v w x y z 0 1 2 3 4 5 6 7 8 9 #

audiofriday – shawarma vs garri كلمات اغاني

Loading...

intro
before before
garri sef na if you like am
but now e compulsory
whyy? whyyyyy?

fellow nigerians
this is just the beginning!

shawarma verse 1

shawarma dey here
only for the rich kids
so stay there
soft life no time
me i stay fresh
elegant cuisine you?
fvck no!
meat pie, donuts don’t come close
sausage, fish rolls and puff puff?
no way!
i’m the king of the small chops
you go see me every time
for your bustop
or your junction for that small shop
dem dey sing my praises nonstop
better ingredients full my body
e no be like you
wey dey give person jedi
i get vegetables
pepper, carrots, garlic
you no get anything bro
so no dey wyn me
i get lettuce, cucumbers and
tomato sauce
the only tin u get
na sugar groundnut
my vitamins, minerals
balanced diet
garri you too fake
like china gadget
i get chicken, hot dogs
they’re beautiful
i get meat
just incase you wan beef too
izz simple
garri verse 1

no need for no introduction
dem carry my own name
win election
just keep quiet and then
check your cupboard
try find to something
wey you don lost
na me
i be garri
i dey for people
in the time of buhari
i dey here before dem
shehu sh_gari
been saving lives since before 1919
and dadi lati
with family of 6
buy one bag of me
to sit down and drink
na because of me
dem get moni for school
cassava, garri and ewa na d tools
when you try save money
i dey for you
sapa flog you like
pikin wey don late for school
but like starboy i dey for you
and i cheap die
you fit even pay for 2
i get many many fine dish
drop small ice cubes
with fried fish
carry beans carry suya
fantastic
add milk add sugar
i like this
asin
na me first start swallow
eba for the boys dem
for the girls dem
bro your thinking shallow
i no beef you
cos’ with garri imma k!llishi!
so bring it in
shawarma verse 2

your flows dry pass you
you wey you need water
to revive you
even goldenmorn dey outshine you
and semolina
don dey take your title

shey u fit use garri toast babe?
n_gga saying shii
talking about those days
people dey drink garri
and it’s so wild
dem dey lose their vision
dem dey go blind
but e me na future
so bro don’t cry
dem dey take you
behind closed doors
they’re ashamed of you
so don’t talk
i don finish dis guy for beat
oh lord

garri verse 2
n0body dey ashamed of me
dem dey fall back
when dey no get moni
i dey everywhere like mtn
you dey talk like say
you get empty head
if you no acknowledge me
tie niyen
i’m depended upon by many men
i dey show for conference meeting
i’m chilling even with ekiti pikin
and i’m reigning in every season
you go bellefull with no shi shi
majority of people dey pick me
upper class middle class and
sapa class need me
finish!

outro
your lunch will not be imported
the dinner will be cassava, eba, ewa

كلمات أغنية عشوائية

اهم الاغاني لهذا الاسبوع

Loading...