kalimah.top
a b c d e f g h i j k l m n o p q r s t u v w x y z 0 1 2 3 4 5 6 7 8 9 #

trevor dulla - free us lyrics

Loading...

[intro]
yh (bro)
bro, yh (maaaddd!!!)
i say my name is trevor dulla (yh)
trevor du, du (oh sh_t gon crazy)
tecka
bro

[verse 1: trevor dulla]
advice dey sweet for mouth when no be u get the problem
no gimme advice ontop matter wey money fit solve em
many problems man dey face, use my rizla take mole dem
mary jane, sweet girls on white dress be like model
e no go sweet make ur pikin ask why u no hustle papa
i no fit put eye for my guy own make e no cause quanta
head burn, papa god make u change am for my matter
i want make my money dey reflect untop my mama wrapper
e don red, papa god only you i fit run to
e don burst, and only u fit turn eba inside bottle
people of the world before them help you dem go f_ck you
man dey burst man for abuja and me no wan go disgust you
inside that squad dem get squad you no get money demma ghost ya
your girlfriend no gat u o. so so pablo’s na dey toast her
u no get money, family meetings cef dem no go host ya
go hard or go hard bro am a son of a hustler
[chorus: tecka mars & trevor dulla]
make dem free us!! (make dem free us!)
who say money no dey bring joy (who say money no dey bring joy)
man no be jesus (man no be jesus)
i thank god for my grace cos
dem for don lap me for this junction (for this junction)
many people no believe us (ma people no believe us…)
i get stars and i get box (i get stars and i get…)
money bringing me much joy, i want more

[refrain: tecka mars & trevor dulla]
free us!!! (free us!!!)
fight for freedom!!! (fight for freedom)
please believe us (please believe us…)
man no be jesus… (yh i gatch you)

[verse 2: trevor dulla]
bro. where i come from even for biscuit cef you go sweat
1 slippers 2 short knicker… i dey wear my mummy shirt
your parent give u want, mine na wetin dem get
stone that pikin wey no get helper still no get sense
if na garri aristotle drink for school him for no know book
e no go sad make na convoy carry my pikin go school
everybody dey hot e come be like i dey cool
na why steady i dey smeck netso studio dey cook
bro na music be my plan a na music be my plan b
shout out navie vibes, dablamar, ma n_gga babi
we start this sh_t together remember government day bwari
forget story just want let u know say music be my cabi
god go run am for you. yes u wey dey vibe my song now
number don’t lie yes i don dey feel among now
money don dey come we dey pray make e long now
ahead ahead bro your tap no go run down
[chorus: tecka mars & trevor dulla]
make dem free us!! (make dem free us!)
who say money no dey bring joy (who say money no dey bring joy)
man no be jesus (man no be jesus)
i thank god for my grace cos
dem for don lap me for this junction (for this junction)
many people no believe us (ma people no believe us…)
i get stars and i get box (i get stars and i get…)
money bringing me much joy, i want more

[refrain: tecka mars & trevor dulla]
free us!!! (free us!!!)
fight for freedom!!! (fight for freedom)
please believe us (please believe us…)
man no be jesus… (yh i gatch you)
ladies and gentlemen…
smeck…

كلمات أغنية عشوائية

اهم الاغاني لهذا الاسبوع

Loading...