kalimah.top
a b c d e f g h i j k l m n o p q r s t u v w x y z 0 1 2 3 4 5 6 7 8 9 #

mg pablo - abudulahi كلمات أغنية

Loading...

verse 1

abdullahi tell me why _ why you had to go…
i still remember promises you made to mama years ago
abdullahi na my guy _ n_gga wey dey calm…
he be cooler than an ice mehn _ this n_gga no get qualms…

abudulahi no get time _ but he dey like some watches…
financially he fit red but steady e dy eye those porsches…
when he dy the dark na allah dey shine he torches…
started on the right foot _ nah hе never needed clutchеs…

abdullahi na from the street _ you suppose know how e dey be…
mumsy dey work for gov _ most times dem find am hard to eat…
abdulahi the only son _ and he get like 3 sis…
he don drop out from school _ since through primary 6

abdulahi too dey smart and he loyal as he be…
so one egbon for area don dey chuck am with the pin…
don dey send am all the kpo _ don dey send am all the trees…
i no believe my eyes first time i see am smoking trees…

abdulahi still too young _ all of us dey like 14…
but he no dy sleep for house _ dem no dey see am for like weeks..
the last time i see am he say he go try to change…
but e no dey let am do cause egbon dey give am change…
i know say you gats survive _ even me i no fit feed you…
but no put your hand _ for anything wey go k!ll you..
he tell me say gvdafi calm down_ you too dey bother…
if i dull like you dey tell me _ who go come dey feed my mother…

shortly e never too tey abdulahi don dey push…
every kind of drugs _ plus e don still enter bush..
he tell me make i follow up _ he say i too dey goof…
say the goal na to stack the papers till e break the roof…

my n_gga don be druggie now he dey do ice and coke…
he said i rather rich and die young than living long and broke…
as he dey clear me how e be _ i swear my eyes dey soak…
cause this n_gga be like bro to me _ and i love am no be joke…

i still remember when he tell say dem k!ll one of he guy…
i saw his heart gettin cold _ i see the fears up in his eyes…
he say i for don craze if no be say me i dey high…
he say like 5 n_ggas must drop for him n_ggas when dem kpie…

gang life na him family _ and drugs be his escape…
every night he dy stay awake _ dey think about he fate…
him mumsy don notice for long _ every night na she dey pray…
but evil wey he do for night must catch up by the day…
one faithful night like that _ we dey our bed dey sleep…
when we heard several gunshots _ bullets dey rain for our zinc…
we think say na armed robbers _ so we hurry call police…
but dem no agree to come _ dem put the line for busy…

i almost die from fear that night _ non of us fit sleep…
the thing affect so deep _ now i get ptsd
straight i go down on my kneels _ pray the lord my soul to keep…
i look my mumsy for her eyes _ i observe say she dey weep…

day break everywhere calm _ some people gather down the street…
for my mind na wetin sup last night dem dey reason for real…
now i say make reach there _ so i go know what’s up the deal…
as i dey get close _ who i see na nurudeen..

na him come chuck me the pin say my n_gga man don go…
as i step further _ i see my n_gga man for cold blood…
e pain me reach my bone when i see him mumsy dey groan…
plus him 3 sis dem dey cry without control
abudulahi why you go…
abudulahi why you go like this?

كلمات أغنية عشوائية

كلمات الأغنية الشائعة حالياً

Loading...