
leanball - i no mind كلمات أغنية
i no mind
o wai
baby i dont mind
no
i no care if na bow or you get k leg
i no send if your ynash get stretch mark
i no care if your papa name na paulinus
or even if your mama dey sell ugu or agbalomo
i no mind if na real or na fake bobbie
i no send if na black or na pink lip
i no care whether you go school for oxford
or even if you be elementary school dropout
i no mind if na face me i go face you
i no care if you dey live with like eight crew
i no send whether you sneeze on me like achew
see i no mind if na garri me and you dеy chew
i no mind
o wai
baby i dont mind
no
i no mind if you get pikin with another man
i no carе if you be friend with like many men
i no send if you pretend say you in love with man
see i no care even if you no get any hand
i no mind even even if your mouth dey smell
i no care even if you say you no like nacking
i no send even if we dey so far apart
i no mind because na only you wey dey my heart
i no care whether you be igbo or yoruba
i no care whether you fulani or hausa
i no send whether na kogi state or calabar
and i no mind whether you oyo or anambra
i no mind
o wai
baby i dont mind
no
i no mind
o wai
baby i dont mind
no
i no mind whether you sabi book or you no sabi
i no mind whether you call me baller or you call me papi
i no mind whether you be lepa or you be orobi
i no mind hmm
baby i no mind
i no mind whether you sabi xook or you no sabi
i no mind whether you call me kika or you call me crazy
i no mind whether you be yellow or you be blackie
uhn see see
i no mind
i no mind
o wai
baby i dont mind
no
i no mind
o wai
baby i dont mind
no
i no mind
o wai
baby i dont mind
no
كلمات أغنية عشوائية
- reaper7man - dababy - lonely ( كلمات أغنية
- isac leon - interview كلمات أغنية
- na'kel smith - love yourselff كلمات أغنية
- blp kosher - zamboni كلمات أغنية
- luis r conriquez & lenin ramírez - la belikiza كلمات أغنية
- bedspin - under your thumb كلمات أغنية
- el zoinko - the very first zoinkmas كلمات أغنية
- young nic - gore# كلمات أغنية
- nicki minaj - everybody (clean) كلمات أغنية
- bima - reap what you sow كلمات أغنية