kalimah.top
a b c d e f g h i j k l m n o p q r s t u v w x y z 0 1 2 3 4 5 6 7 8 9 #

avrilson - love na sacrifice lyrics

Loading...

say….what!
some people dey marry and others dey divorce
make you no leave your spouse when sugar finish
love na sacrifice o
i say, marriage na sacrifice

uh, i get somtins wey i wan yan
open ya ears, i beg make you hear am
cos e dey pain me for heart when you tok say marriage no good because of bitterness
shebi na you bin marry for church, for bitter or sweet, remember di vow
christ bin die for dis matter
na only sacrifice bin dey curе for dis matter
una fit live togethеr like brother and sister
yes, in any kind of weather, bella
if, only una go practice wetin bible teach us
inside una marriage
faith and prayers na di solution
yes , when ya marriage bring you down
endure di pain, if you pray with faith you go
stand again

make you no leave your husband when sweetness finish
love na sacrifice o!
i say, marriage na sacrifice
make you no leave your wife when sweetness finish
love na sacrifice o!
i say, marriage na sacrifice
uh, before you enter dat marriage prepare your mind to fight with divorce
no be only sweetness wey dey inside marriage
the time for bitterness go test una love
chai, after the colourful wedding
one year later marriage life taste bitter
no sugar, no sweetness bring bad weather
because bella husband don loss im sugar
oh baby please don’t leave me
i’m doing my best to make things work
na so her husband bin dey cry and beg her
but, bella tok say she go file for divorce

make you no leave your husband when sweetness finish
love na sacrifice o!
i say, marriage na sacrifice
make you no leave your wife when sweetness finish
love na sacrifice o!
i say, marriage na sacrifice

hmm…na sacrifice
love na sacrifice
sacrifice
i say, marriage na sacrifice!

كلمات أغنية عشوائية

اهم الاغاني لهذا الاسبوع

Loading...